Advertisement by Google
M.Y.B.
NibellariShey na my life I dey live,
Nothing really concern you.
So tell me why the hate?
Why all the things I’ve been doing,
Dey bother you?
Why you no fit dey your dey?
Make I dey my dey
Why you no fit mind your business?
Make I mind my own too
See I hustle for my peace,
I no send validation.
People go talk,
But na dem frustration.
I dey run my race,
I no need direction.
Na God dey guide me,
No be man instruction.
(No be man instruction)
(No be man instruction)
(I no oracle man oo)
(But I know all the beaches)
(Nigga weh dey try backstab me)
(Weh no wan see me shining)
Make I dey my dey, you sef dey your lane.
No go carry my matter for your brain.
I no get time for hate or complain,
I just wan hustle make e pay again.
Make I dey my dey, make I find my way.
See I don try oo
Me I just wan flex my life (just wan flex my life)
So when you see me shining
No go reason am too far
Say I dey try oppress you (oh no no ooo)
As you can see
Me I don go through many pain
I can’t even explain ‘cause
Nobody really send (nobody really send oo)
Na why me I just dey my dey, ah
The hustling everyday,
Is for the better future
No competition
(no competition)
(no competition)
And I don’t really know why the hate oo
If you no like my lifestyle
Why you no fit dey your dey?
Mama pray for me o (pray for me o)
Enemies don dey plenty o (don dey plenty)
Me I wan go far, me I wan see far (me I wan see far)
Make I dey my dey, you sef dey your lane.
No go carry my matter for your brain.
I no get time for hate or complain,
I just wan hustle make e pay again.
Make I dey my dey, make I find my way



Comment